Bakassi Blood Dey For Una Head OBakassi Blood Dey For Una Head ODis yeye vampires for Obodo Naija don take we land for Bakassi play lido and draught Abasi go show dem pepper.Se na dem be Abasi wey give we grand-grand apa Bakassi? Wia dey want make
Country people, de Son of man don appear again dis week like lightening with message from Bakassi people to Naija vampires wey carry dia land wey Chineke-God dash dem and dia grand papa and mama go give Kameroun people. De people bin dey trowey curse wey fit bring thunder and fire for de domot of de Animal called man wey wan show say im be beta person for de eye of Oyibo people, come carry dia land dash French-Kameroun people wey dia concern na only oil. My people, de Son of man and im crew of investigashionsprofesshionals wey include, Okochi alias dry weather, Bakana alias Kingpago and Iteigwe alias Iron pot waka go visit Bakassi people and ask dem wetin dey shele, because we hear say Musa and im minister for lawyer matter, Mazi Aondoakka don swear say even if dia grand papa and mama wey don kpeme tey tey come out from grave to beg dem, dey must carry dey final land wey Obusonjo lefu behind to give French-Kameroun people for August, 2008. For dat visit we interview de people of Bakassi and many of dem talk dia mind, abeg make una take style read wetin wey dey talk for down: Hey, wetin be ya name? My name na Okon Friday Etim. Wia be ya town? Me I no get town o, na for dis place my mama and papa born me o, and dey tell me say na here my grand papa and dia own grand papa and mama bin dey live and dey talk say na dia Chineke-God create dia own Ndichie alias ancestors. Ehn, now wey dis vampires from world majes court don talk say dia Ndichie alias ancestral home abi na land belong to French-Kameroun people, wetin dey wan do? My broda, dis kain evil-treatment don pass biati o. Afuo, di sey, dimi, My name na Son of man, I come from Obodo Naija, em, wetin be ya own name and wia be ya own country? Oh, my name na Udeme Basssey Ekpo Yohnson Thursday, my country na Bakassi, we dey for Naija before but Naija leadersheep come sell we to French-Kameroun people but we no agree, so we still dey fight to get we own country from UNO, eventhough de Animal called man wey bin dey rule Naija dat time come use im area scatter behaviour carry part of we Bakassi country go dash Kameroun people because im be wan show say im be world reader nay leader; se una don see wia muumuu dey chop or talk wia beta world people dey? Abeg go tell ya Naija people say dis kain mistake wey dey make go scatter Naija before okeokpa alias cock crow. Country people, as we dey waka dey do de talk talk alias interview with Bakassi man and womanpikins, we come jam one akpuruka man like dat wey to pronounce im name fit make teeth and tongue get accident inside mouth, even im intonashion fit cause brain-fast. To cut short tory long, as we just wan start to ask am queshion, im just takeover de talk talk show with queshions: But before im start, Okochi alias dry weather ask am im name and small queshions? Em my name na Akpabio Okokon Saturday Ndidiem Idoghonsit, na we get Bakassi wey dey inside Efik tribe for Ejagham nashion. Ehn, wetin una dey do wey una still plenty like dis? Se dey talk say Obusonjo talk say make una waka comot from here? Abeg, wetin be dat ya name sef, em, Okochi, Se na im put my grand papa and grand-grand papa here before? Why im go say make we move? na im put we grand-grand papa and we here? Go ask am!!....' Em….wetin be de true matter sef? Wetin dey shele between we and you people sef?. We hear say you people for Naija talk say we no be Naija people again? Ok, we no be Naija. But we no be Kameroon people at all at all…. So we be Bakassi people and Obusonjo or any vampire from Obodo Naija no get any power to carry we land and dash Kameroun or any other country. Hmn….Dat una Obusonjo sef, se de wahala abi na fire wey im put for im family no do am, he want come put we too for inside wahala for ever and ever. God go pun...am My people, me and my crew of tory people think say with people like Akpabio, we don hear dey worst but dey thing wey come out from Effiok Abasimbok mouth pass poison from viper tongue abi na mandible. Na so so curse curse Effiok just dey trowey left and right. Hey, see, e no go beta for una wey dey for Naija, una no go see beta things, de blood of we pikins, wives, husbands wey una leadersheep through dia yeye policies send to early grave dey for una head. Abasi no go forgive una vampire-rulers wey dia sefish ambishion put we for dis wahala. Na for only Naija we don see say gofment fit carry part of dia country dash another country, because dey no value dia people. We dey fast and pray say, Abasi go soon send some vampires to come comot Obusonjo from farm Ota and im go dey homeless like we. All dey bad bad things wey im don do for dis world neva do am, im come dey put eye for Bakassi. Se Obodo America, Israel, China, Britain and other Obodo Oyibo countries dey obey dat yeye world majes court rule. Se UNO law no talk say, na inhabitants suppose to talk wia dey wan stay? Why de Animal called man no use UNO law to challenge dat yeye ruling, se na because im wan take Bakassi bribe Oyibo people so dat dey go allow am do third Term for gofment? We don lefu efery thing for Abasi but make una warn Musa make im stay clear for dis fire wey dey burn so. Why im wan enter wahala wey im no create, se na because na King Kong carry am put for Rock Aso so dat im go continue with im yeye policy to dash Bakassi to Kameroun? We no go allow am, we go join Biafra and declare independa. Dis kain suwegbe akshion no fit happen for Obodo Libya or any Arab Country, even Zimbabwe sef no fit allow dis nonsense from Oyibo people, dat na why dey get respect pass Naija for world matter, alias internashional affairs. Country people, na so we waka with Bakassi people end for dis week, we fit continue with other part next week, insha Allah.
|
|
|
|
|
|