Corrupshion Don Overtake Post-UME Exam OCorrupshion Don Overtake Post-UME Exam OCountry people, de Son of man don show face again dis week like lightening with lamentashions from downtown people pikins wey pass JAMB examinashions with high grade but because dey no get money to buy Ulivasity teachers and workers to pass post-UME exam and get admisshion to read bookru for Ulivasity. Una know say de kain corrupshion odour wey dey smell for different Naija Ulivasity dem pass don't be silly. Se no be for Naija Ulivasities wey we tanda dey see for korokoro eye wia some man and womanpikins from vampires families wey no sabi bookru dey give lecturers ngari alias kickback to get beta grade for examinashions and yet Naija gofment come carry Ulivasity admisshion matter put for dia hands like say dem be angels. Make una check and test some of we womanpikins wey dey carry first-class and second-class upper division certificates dey waka about, una go see say nothing dey for dia head, na Ulivasity teacher-boy friends dash dem de yeye grades because of dia kwokina wey dem take dey do akpara-work for skuul. My people, de Son of man and im crew of investigators wey include, Okochi alias dry Weather, Bakana alias Kingpago and Iteigwe alias Iron pot waka go visit some Ulivasities and ask post-UME candidates alias Jambitos wetin dey shele, because we hear say water don pass garri for admission matter. Before we go open mouth sef to ask queshions from dem, na so so cause and swear come dey surface from dia mandible. Many of dem talk say na some vampires for gofment wey dia pikins no fit pass JAMB exams alias UME go do meeting to introduce dis 419 post-UME nonsense so dat dey can easily waka like fowl wey wan lay egg for apia way enter any Ulivasity and bribe some hungry lecturers to workout admisshion for dia pikins. Na only for Naija de Son of man don see say one skuul pikin fit write two different exams for one admission. No be say de exams na free o, some of de Ulivasities dey collect plenty money to allow Jambitos write de post-Ume exams. Sometimes sef poor Jambitos wey no get dat kain money but wey pass UME with high grade dey miss de post-UME nonsensical exam. True true, dis vampires sabi wetin dem dey do for dia own sefish goals. Abeg, make we lefu dis vampires and dia yeye life alone. How manpikin go work hard to pass UME exam with beta grade of 240 and above only to be dropped because im no sabi somebody for Ulivasity and one isiaku alias coconut-head wey no sabi im left from im right wey score below 140 go come get admisshion for Ulivasity, after dis kain nonsense Naija people go come dey shout say we country no dey move forward, how we country go move forward wen mediocrity alias suwegbe dey reign supreme for efery facet of we life? Country people, make we take style visit dis Omonile wahala for Lagos again. Dey kain wahala wey dis efulefu people dey cause for Lagos don dey pass biati o. Em, de Son of man still dey wonder weda na Gobinor Fash give dem power to dey do katakata for gburugburu Obodo Lagos. I know many people wey don suffer for one way or de other from de wahala of dis area urchins called Alaye. How manpikin go buy land to buy small house wey im and im family go hide dia heads from sun and rain and de so-called Omonile people no go allow dem build am, dey go come scatter dey house until dey collect two hundred thousand naira each for foundashion and roofing? Sometimes dey go beat and kill de workers for dey sites and Olopa alias Police go see dem, carry face trowey for evil forest like say no be dia work to protect Naija citizens. Country people, out of all dis Omonile nonsense, de one wey dey pain me pass be say, if ya papa house or ya house de leak and you wan change de zink, dis efulefu people go waka like lion wey dey pursue antelope to come stop work. Last week, wey just pass so for Olanrewaju Street wey dey for Sango-Area, Agege, some people wey dia family house bin dey leak, because wind blowout de zink wey dey for dia house and dey go call Karpenter people to repair de roof, as de people dey work na so de Baale for Keke Area, wey dey for Lagos Street, Agege come carry battalion of area boys waka like manpikin wey don shack Ibo alias ganja to come stop de work, because according by him, de people no come pay homage and pay am some money as de King-Kong of de area before dey de come dey plan to repair dia zink wey wind comot from roof. De Baale talk say, if any manpikin comot roof from im house, automatically im tenancy don expire and im suppose to buy de land again or e go turn to im own. Dis Baale people dey see demsefs like dey owners of all de lands for dia areas o. Time don reach wen gofment go save Eko citizens from dis omonile wahala o. Se Lagos state gofment support dis kain nonsense? E like say, de gobinor support am o… because if dey no support am, dey suppose to don ask security people to stop dis illegal exploitashion or warn dis Baale people to stop giving Lagos people wahala. See ya next week, insha Allah.
|
|
|
|
|
|