Last Supper for Madam Stock Exchange?Last Supper for Madam Stock Exchange?
For Naija, na one week, one news. Once you hear am today, everybody go
begin talk about am, by the time you wake up, that one go just blow
pass. Anoda thing go begin shele.
I remember that time wen be say na only Madam Speaker Etteh, we just
dey hear. From morning till night, na only Etteh, person go dey hear
for radio, watch for TV, read for newspaper. Etteh powerful so tay, one
honourable member use him life put down for am sef. Na that time, me
wey be Charly Moore, hear one slang wen dem dey call Banana Peel.
That time sef my colleague for this okada work, Baba Bose, think say
Banana Peel, na that yellow type when we dey buy for Underbridge. The
dey when I tell am say na only for National Assembly, Banana Peel dey,
e just bow. E no know say that one na National Assembly slang. Na dat
one make the man today dey always meet me whenever e wan know weda new
slang don comot. But I dey always tell am say, na news dey bring slang,
say na small small, the thing dey take come.
From Etteh, the next thing wen happen na Bankole. As the bobo become
Speaker na im people begin the next slang NYSC certificate. But before
dem go know am, the bobo bring am kia kia. People for underbridge that
time talk say that Banana Peel, no ripe well. Yes, they say as e no
bring Bankole down, say na unripe banana be that.
Trust Naija for news, after the power probe panel, the next thing wen
we dey hear na say Bankole buy motor. Some people go dey talk dey go
left, right and centre say e no suppose buy the cars, but some people
dey talk say the motor wen dem get na official cars.
As the official car matter dey shele, na im Madam Stock Exchange, come
enter slang too. Her wahala, just be say, she support Barack the son of
Obama. Na as I read the paper about Madam Stock Exchange, I bow sha. So
that kind money dey for this Naija sef? I hear say some people use
three million naira shop dinner just to support Barack Obama for Ame.
If that one work like that, na im be say, money wey dey use shop
dinner go buy all the Okada wen dey underbridge, plus the ones wen dey
Allen Junction. In fact, e fit buy all the okada for Lagos sef. After
all, how many we dey? Honestly, that kind dinner no be small one. If na
dat time, wen we dey secondary school dey do guy, we dey call that kind
dinner, one in town dinner.
Na for underbridge, I see say the wahala wen follow that dinner too
much. Small time, dey talk say EFCC don arrest am, come release am,
small time Lai Mohammed begin holla, say make the woman just resign.
One man wen follow us read paper for underbridge say the one wen make
am vex for that matter na the anakara wen the people wear for that
fund raising. In fact, na only God know wetin go dey happen wia Madam
Ndi dey now. When I check the matter with Baba Bose, e talk am
koro-koro, say e be like say this one na last supper for Madam Stock
Exchange o. We dey look sha.
|