horizontal advert
Home   |   About   |   Subscribe   |   Archives   |   Contact Us   |   Search  |   Weekend Last Editions Monday, January 05 2009
News Cover Sports Politics Editorial Business Foreign News Classified Backpage Forum Brand/ Promotion
Real Estate Crime Arts OP-ED Metro Insurance Finance Travel & Tourism Info - Tech Features Education


Downtown


Last Supper for Madam Stock Exchange?

Last Supper for Madam Stock Exchange?

For Naija, na one week, one news. Once you hear am today, everybody go begin talk about am, by the time you wake up, that one go just blow pass. Anoda thing go begin shele.
I remember that time wen be say na only Madam Speaker Etteh, we just dey hear. From morning till night, na only Etteh, person go dey hear for radio, watch for TV, read for newspaper. Etteh powerful so tay, one honourable member use him life put down for am sef. Na that time, me wey be Charly Moore, hear one slang wen dem dey call Banana Peel.
That time sef my colleague for this okada work, Baba Bose, think say Banana Peel, na that yellow type when we dey buy for Underbridge. The dey when I tell am say na only for National Assembly, Banana Peel dey, e just bow. E no know say that one na National Assembly slang. Na dat one make the man today dey always meet me whenever e wan know weda new slang don comot. But I dey always tell am say, na news dey bring slang, say na small small, the thing dey take come.
From Etteh, the next thing wen happen na Bankole. As the bobo become Speaker na im people begin the next slang NYSC certificate. But before dem go know am, the bobo bring am kia kia. People for underbridge that time talk say that Banana Peel, no ripe well. Yes, they say as e no bring Bankole down, say na unripe banana be that.
Trust Naija for news, after the power probe panel, the next thing wen we dey hear na say Bankole buy motor. Some people go dey talk dey go left, right and centre say e no suppose buy the cars, but some people dey talk say the motor wen dem get na official cars.
As the official car matter dey shele, na im Madam Stock Exchange, come enter slang too. Her wahala, just be say, she support Barack the son of Obama. Na as I read the paper about Madam Stock Exchange, I bow sha. So that kind money dey for this Naija sef? I hear say some people use three million naira shop dinner just to support Barack Obama for Ame. If that one work like that, na im be say, money wey  dey use shop dinner go buy all the Okada wen dey underbridge, plus the ones wen dey Allen Junction. In fact, e fit buy all the okada for Lagos sef. After all, how many we dey? Honestly, that kind dinner no be small one. If na dat time, wen we dey secondary school dey do guy, we dey call that kind dinner, one in town dinner.
Na for underbridge, I see say the wahala wen follow that dinner too much. Small time, dey talk say EFCC don arrest am, come release am, small time Lai Mohammed begin holla, say make the woman just resign.
One man wen follow us read paper for underbridge  say the one wen make am vex for that matter na the anakara wen the people  wear for that fund raising. In fact, na only God know wetin go dey happen wia Madam Ndi dey now. When I check the matter with Baba Bose, e talk am koro-koro, say e be like say this one na last supper for Madam Stock Exchange o. We dey look sha.

Other Stories In This Section

States of Nigeria
Abia | Abuja FCT | Adamawa | Akwa Ibom | Anambra | Bauchi | Bayelsa | Benue | Borno | Cross River | Delta | Ebonyi | Edo | Ekiti | Enugu | Gombe | Imo | Jigawa | Kaduna | Kano | Katsina | Kebbi | Kogi | Kwara | Lagos | Nassarawa | Niger | Ogun | Ondo | Osun | Oyo | Plateau | Rivers | Sokoto | Taraba | Yobe | Zamfara

Auto Mart Shipping Science Children Aviation Health Mirror Gal Job Mart Interview Mirror Law Education Mirror Doctor
Home    |    About Us    |    Contact Us    |    Advert Rates    |    Check Mail    |    Archives    |    Subscribe    
Copyright 2008® National Mirror News          Designed & Powered by dnetsystems.net dnet®